Coup in DR Congo: 'Attempted coup' in DR Congo fail, army - BBC News Pidgin (2024)

Coup in DR Congo: 'Attempted coup' in DR Congo fail, army - BBC News Pidgin (1)

Di Defence and security forces of di Democratic Republic of Congo announce on Sunday say dem don scata one attempt of coup d’etat for di capital, Kinshasha.

Dem tok say dem succeed spoil am sharp sharp bifor di plan work.

Di Presidential guard set up roadblocks to stop motor dem and pipo wey dey waka so dat dem no go fit reach di area around di Palais du Peuple - di office of di President of di kontri.

Even wit all dis roadblock armed men wey dem no fit identify enta di place bifor daybreak on Sunday.

Tok-tok pesin for di Congolese army, Brigadier General Sylvain Ekenge tok for national television few hours afta di incident, about di attempted coup d’etat.

“Di armed forces of di Democratic Republic of Congo inform nation and international opinion say di Defence and security forces stop an attempted coup d’etat,” na Wetin di Army tok-tok pesin tok.

E give assurance to evribody for di Democratic Republic of Congo to go about dia businesses freely and quietly.

Wetin happun

Security sources tok about di attack wey start between 3 and 4 a.m, di first place dem attack na wia di Deputy Prime Minister wey dey in charge of di economy and di only candidate for di post of Speaker of di Lower House of Parliament dey stay.

Later, men wey wia military uniforms occupy di Palais de la Nation, di office of di President of di Republic for di centre of di city, di area wey dey highly secured by di Republican Guard.

‘I bin come around 5am and see two deadbody of security forces for ground and shell casings in front of Vital Kamerhe house’, one security source tell di BBC.

According to MP Michel Moto, one of Vital Kamerhe close friends, wey be di only candidate for di post of president of parliament dey in good health and im entire family dey for im house for Gombe.

Wetin we know about di attackers and wetin dem want?

Coup in DR Congo: 'Attempted coup' in DR Congo fail, army - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Malanga/Facebook

Christian Malanga na former Congolese military officer wey dey resides for di United States wit im family.

Dem born in Kinshasa, 2 February 1983 – e dey call im sef president of di United Congolese Party (PCU).

Dis na national political party wey form afta im experience during di 2011 parliamentary elections.

Dem name am di first ambassador of di International Roundtable on Religious Freedom for 2013.

Afta e disappear from di radar for several years, Malanga reappear on Sunday morning for di Palais de la Nation during di armed attack wey e lead.

Christian Malanga dey popular for im hostile videos against di regime of President Félix Tshisekedi from di USA, wia im bin dey base bifor dis attack on di office of di President of di Republic.

Fotos wey dey fly upandan for social media show a dozen of men wey wear military uniforms, dem carry AK 47. One of dem say ”Tshisekedi out” wey dem believe say mean Christian Malanga for English.

Di armed group bin also show-off flags of Zaire, di former name of di Democratic Republic of Congo under di late Mobutu, dem claim say dem want new regime. Di man wey dey behind di attack na Christian Malanga.

Dem identify am for one video wey dey circulate for social media, around 20 men na im escort am for di presidential palace, wia im claim responsibility for di attack.

Im tok for Lingala dia local language say, 'God dey great, dear brodas! We, di military, don tire. We no go fit march togeda wit Vital Kamerhe and President Félix Tshisekedi.’

Im claim to be di president of di United Congolese Party. For one point im announce say wetin dey im mind na to contest for di 2023 elections. Im also present imsef as former member of di Congolese Armed Forces.

Im dey 41 years, and dem believe say im die on Sunday during di operations wey di special forces do for di presidential palace area, according to plenti sources.

  • All you need know about Democratic Republic of Congo 2023 presidential elections
  • DR Congo President Felix Tshisekedi don win re-election
  • Wetin dey happun wey make citizens dey protest against USA, France for DR Congo
Coup in DR Congo: 'Attempted coup' in DR Congo fail, army - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, PRESIDENCE.CD

Kinshasa, wia dem dey nurse armed attacks

Dis no be di first time wey dis type of attack dey happun for di Congolese capital. Similar events bin don already happun for Kinshasa.

For December 2013, Pastor Gideon Mukungubila men bin attack di Congolese national television station and oda strategic locations for Kinshasa. Mukungubila currently dey live for exile for South Africa.

For May 2017, followers of anoda religious leader attack di largest prison for di kontri wia dem bin hold dia leader, Ne Muanda Nsemi captive.

Dem bin succeed to free am wit plenti oda detainees afta di kasala wey dem cause for di Makala central prison.

Di Congolese authorities dey announce further releases in di near future. for di meantime, militants close wey dey close to di ruling party don block di avenue wey dey lead to di house of di President mother for di Limete community, di headquarters of di President political and biological family.

Coup in DR Congo: 'Attempted coup' in DR Congo fail, army - BBC News Pidgin (2024)

References

Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Rev. Porsche Oberbrunner

Last Updated:

Views: 5953

Rating: 4.2 / 5 (53 voted)

Reviews: 92% of readers found this page helpful

Author information

Name: Rev. Porsche Oberbrunner

Birthday: 1994-06-25

Address: Suite 153 582 Lubowitz Walks, Port Alfredoborough, IN 72879-2838

Phone: +128413562823324

Job: IT Strategist

Hobby: Video gaming, Basketball, Web surfing, Book restoration, Jogging, Shooting, Fishing

Introduction: My name is Rev. Porsche Oberbrunner, I am a zany, graceful, talented, witty, determined, shiny, enchanting person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.